Pep Guardiola wey be Bayern Munich coachi don tok say dem go miss
dia ogbonge guyman wey no dey miss action sam sam, David Alaba as Bayern
club doctors don tok say hin go do knee operation.
De 22-year-old dey suffer ruptured ligament an meniscus wahala for hin right knee, wey
bin get for dia 2-kondo win over AS Roma for de Champions League wey shele for Wednesday.
Na afta hin don arrange betta ball for Franck Ribery wey hin carry waya de opener goal wey be hin 17th start for de Munich giants dis season.
"hin fit komot for two or three months, but we fit get am back afta Christmas", naso Guardiola yarn de club website.
Guardiola don tok say de kain swagger wey Alaba get go make de club miss am well well for pitch.
"Hin be complete player, na guy wey fit play different-different positions all over de pitch we dey tok about, hin be big guy, na top player we wan miss be dat".
Hans-Wilhelm Muller-Wolfhart wey be Bayern Munich doctor bin do player tests for plenty hours for Thursday and tok say na for some weeks wey Alaba go komot.
"Na bitter medicine e bee to swallow", naso Alaba wey dey play left-back or midfield tok.
"Especially as everything dey work well for me and de club".
Alaba don play 49 times for Bayern Munich as dey do de German league and Cup double lass season.

Title : Alaba injury dey pain Guardiola
Description : Pep Guardiola wey be Bayern Munich coachi don tok say dem go miss dia ogbonge guyman wey no dey miss action sam sam, David Alaba as Bayer...

0 Response to "Alaba injury dey pain Guardiola"
Post a Comment