Powered by Blogger.

Eagus nack Ghana 1-kondo for Uyo

Eagus of Naija bilala Ghana 1-0 for deplay play match wey dem play on Friday nite for de Uyo International Stadium.De padi padi game wey happen between Naija and Ghana na hin dem take open de new Akwa Ibom International Stadium wey dey for Uyo.Naija take swagga start de match for de fess half as dem dey find how dem go waya Ghana,but Ghana boys no gree for dem as dem close dia yarns well well.Warri Wolves strika, Gbolahan Salami see betachance wey hin for take score wen de match enta 20 minute, but de guyman troway am.Na for de 33 minute na hin Naija kon score degoal wey dem take win de match. Dolphins sabee strika, Emem Edouk na hin take hin head score de goal for Eagus.E mean say na Emem go be de fess playa wey go score for dis Uyo international Stadium.De second half na pure water as Ghana try make dem ekwalise, but Naija no gree for dem and naso de Eagus take win de match 1-0.All de Supa Eagus playas kon dey dance skelewu afta dem carry de transformation cupgive dem for de Uyo Stadium.

posted from Bloggeroid

Title : Eagus nack Ghana 1-kondo for Uyo
Description : Eagus of Naija bilala Ghana 1-0 for deplay play match wey dem play on Friday nite for de Uyo International Stadium.De padi padi game wey hap...

0 Response to "Eagus nack Ghana 1-kondo for Uyo"

Post a Comment

Pageviews past week