Powered by Blogger.

Barca, Real no gree drop points

Barcelona don win dia fes match inside two matches for La Liga as dem come from back take beat Almeria 2-1 for match wey shele on Saturday.
De Catalans bin lose 3-1 to Real Madrid for Bernabeu, come drop anoda three points for house wen Celta Vigo beat dem 1-0 las week.
But dem don dey win now as dem beat Ajax 2-kondo bifor dem win Almeria wey
bin wan do dem boju-boju.
Almeria no siddon wait for Barca to setul bifor dem begin attack dem upon say Barca coachito Luis Enrique bin drop Neymar, Xavi and Luis Suarez for bench.
Congo striker Thievy Bifouma come chuk hand for Barcelona eye as hin score de fes gol of de match as Barca bin no fit put dia shoe well for de match.
Dat Theivy gol for de 37th minute come wake Barca as dem begin find gol.
Luis Enrique come start de secon haf with hin sabi playas as Suarez and Neymar enta and na de two of dem come combine ekwalise for Barca.
As match dey enta mortuari time na so Luis Suarez again come locate Jordi Alba wey run enta Almeria defence and de defenda sef come nak ball enta net for de 82 minute to make am 2-1 and na so de match finish.
Real Madrid shoe beta form for Bernabeu as dem take one hand bakhand Rayo Vallecano 5-2.
Cristiano Ronaldo sef score for de match as Gareth Bale wey just show from injuri add hin name for de parade.
Toni Kroos, Karim Benzema and Sergio Ramos na de oda playas wey score for Real Madrid as Alberto Bueno be de play wey score for Rayo Vallecano.
Title : Barca, Real no gree drop points
Description : Barcelona don win dia fes match inside two matches for La Liga as dem come from back take beat Almeria 2-1 for match wey shele on Saturday...

0 Response to "Barca, Real no gree drop points"

Post a Comment

Pageviews past week