As Liverpool dey prepia to follow Chelsea play on Saturday, nobodi go
tell dem say de 2-kondo wey Chelsea waya dem las season, spoil dia plan
to win Premier League title for de fes time, since 1990.
Liverpool skippo, Steven Gerrard, bin fall yakata, helep Chelsea score dia fes goal, bifor dem score numba two for mortuary time. Jose Mourinho dey carri Chelsea go Liverpool now
, wit 12 point gap between two of dem, and na four point dem dey carri gap Southampton for second.
As Luis Suarez waka comot Liverpool, go join Barcelona, plus Daniel Sturridge come carri wound, na onli 13 goal dem don score for de 10 match wey dem don play dis season. Bicos Newcastle and Real Madrid waya dem for two strait match, gbege dey ontop dia coachi, Brendan Rodgers, head.
"We no dey try," na im Rodgers yarn amebo pipu on Thursday. "We dey try fin how we fit score plenti goal."
"De match go tuff for us, sake of say dem neva troway any match. Chelsea gada sabi-sabi, plus playas wey don dey dia since."
Many guymen bin yab Rodgers, afta hin carri one kin yamayama team play Real Madrid, for Champions League on Tuesday, sotay hin leave Gerrard and Raheem Sterling ontop bench, as Real waya dem 1-kondo.
"I carri boys wey I bin feel say go fit play Real Madrid. My playas over try sef," na im Rodgers tok.
But some forma Liverpool playas don tok say Rodgers yab, as hin no show say Liverpool don win Champions League five tines.
"Dat one no konsin me. Tok, tok no dey worry me," na im Rodgers tok.
"Na to jus face ya work. Anytin I do, na Liverpool dey my mind.
"Our plan na to stay de match reach 65 minit, come opun am as de tin wan finish. De playas make my mind sweet."

Title : Liverpool mind na water as Chelsea dey come
Description : As Liverpool dey prepia to follow Chelsea play on Saturday, nobodi go tell dem say de 2-kondo wey Chelsea waya dem las season, spoil dia...

0 Response to "Liverpool mind na water as Chelsea dey come"
Post a Comment