Na dis weekend, Morocco get for dem to decide weda dem go host de 2015 African Nations Cup as dem dey fear spread ofEbola virus but fit face heavy sanction against dia football teams.De host nation wan make CAF shift de January 17-February 8 game becos of de bad virus weydey kill pasin pass poison but de Confederation of African Football (CAF) no gree change de dates sam sam as dem wan decountry to make dia final decision for Saturday.CAF don tok say na big noise Morocco dey make about Ebola as dem dey fear say de competition go carry plenty visitors wey reach tens of thousands from west Africa wia almos 5,000 don die becos of Ebola enta dia land.De Confederation bilif say na small thousand of fans wey go waka enta Morocco for de game and kon tok say na only Guinea wey never kwalify yet get de virus ."We understand say de country wan dey careful well well, but e dey important say demno go begin dey stigmatise de virus and kon increase de fear wey pipu don already get for de virus, instead make dem check how de virus no go waka from one place to de other and control am", naso CAF general secretary Hicham El Amrani tok dis week.Mohamed Ouzzine wey be Moroccan Youth and Sports minister don tok say de puplic fit dodge de tournament and players wey dey tapball for Europe no go follo for de de game for de game to scatter for all wey de game concern.Ouzzine's country fit face sanctions if dem konwithdraw as hosts wile CAF don dey plan for de game wey dey give dem money yanfu yanfu through marketing and television.CAF wey wan force morocco to change dia mind never see any other country wey gree kolet de hosting as emergency hosts.If Morocco kon withdraw, and CAF kon no see anoda venue, na hin be say dem go cancel de 16-team competition.
posted from Bloggeroid
Title : Morocco fit face Caf Sanction
Description : Na dis weekend, Morocco get for dem to decide weda dem go host de 2015 African Nations Cup as dem dey fear spread ofEbola virus but fit face...
Description : Na dis weekend, Morocco get for dem to decide weda dem go host de 2015 African Nations Cup as dem dey fear spread ofEbola virus but fit face...
0 Response to "Morocco fit face Caf Sanction"
Post a Comment