Powered by Blogger.

Dem dey find Enyeama for England

Two ogbonge clubs for England wey dia name be Liverpool and Sunderland don dey take style dey find Supa Eagus numba 1 golkipa, Vincent Enyeama.
Na for France na hin
de tori don dey flow like water say Liverpool and Sunderland fit carry money go buy Enyeama ness year January.
De reason wey make Sunderland dey find Enyeama be say dia fess choice golkipa, Vito Mannone don chop 10 gols for dia lass 2 games against Southampton and Arsenal.
Liverpool for dia own side dey find Enyeama sake of say na only Simon Mignolet be de fess golkipa for de club.
Meanwilly, no be today na hin tori don dey enta say Sunderland and Liverpool dey find Enyeama, but as e be now, de guyman fit enta England ness year.
Lass year September, tori dey ground say Enyeama fit enta Sunderland, but de transfer no gree work for am.
Enyeama dey tap ball for Lille wey be club for inside France, and na 2017 na hin im contract go kpafuka.

Title : Dem dey find Enyeama for England
Description : Two ogbonge clubs for England wey dia name be Liverpool and Sunderland don dey take style dey find Supa Eagus numba 1 golkipa, Vincent ...

0 Response to "Dem dey find Enyeama for England "

Post a Comment

Pageviews past week