Powered by Blogger.

Chelsea neva pure - Mourinho

Chelsea coachi, Jose Mourinho no gree hear say hin team fit no chop beating dis season, afta dem waya Liverpool 2-1 on Saturday.
Diego Costa score de goal wey Chelsea take kolobi Liverpool, as match reach 67 minit for Anfield
(Liverpool stadium) on Saturday, as Chelsea neva troway any match since March, come dey make guymen tok say dem fit do wetin Arsenal do for 2003-2004 season.
Mourinho tok say all de yarn wey guymen dey yarn, say Chelsea fit copy Arsenal, no troway any match, na moin-moin tok.
"Lailai," na im hin tok, wen dem ask am weda e fit hapun.
"We fit be champion. Na wetin we dey plan. But de way futbal dey now, I no tink say we fit play de whole season make persin no waya us.
"Persin go waya us one day, but we go still win afta dat one. We go play worwor futbal but we go still show oursef bicos our mind strong.
"Our team balance but I don tay for futbal and I know say dat time go come wen our futbal no go pure. We dey prepia for dat time. I get confido for evribodi. Our playas mind rest."
As Chelsea win dat match so, na 15 point dem dey carri gap Liverpool now, even tho na second Liverpool bin finish las season. E bin be like say Liverpool fit win league sef, until Chelsea waya dem las season.
Upon all dat one, Mourinho neva wan gree say Liverpool own don finish, or gree sef, say league don end.
"If to say na Spain league, or Germany league or Portugal league, wey be say na onli two club dey always try, den 15 point na sure banker," na im Mourinho tok.
"Dis na Premier League. Evri match tuff. You fit troway any match. No be onli Liverpool dey. Manchester City, Manchester United and Arsenal dey. Tottenham and Southampton sef, join bodi.
"We tanda for coret place bicos we don alredi waka go Everton, Liverpool, Manchester City and Manchester United. No be easy place dem be, and na November we jus enta so."
Mourinho bin tanda, look, as Gary Cahill fes ekwalise Emre Can goal, bifor Diego Costa score winning goal, and hin hail hin midfildas; Cesc Fabregas and Ramires, sake of say de two of dem carri wound, but dem still play ball.
Brendan Rodgers go don vex sha, sake of say Liverpool bin suppose get penarity afta Cahill carri hand touch ball, but de coachi gbege no be small tin, afta dem chop beating for Newcastle and Real Madrid hand.
Guymen bin rake for Rodgers sake of say hin bin rest hin ogbonge playas, wen dem bin follow Real Madrid play, but de coachi no gree hear, as hin tok say he go do am again.
"I for try win all de match," na im Rodgers yarn, wen dem ask am weda hin for change format if hin get chance again. "But we dey plan our playas and our team de way we tink say e go work. I no for change anytin.
"Na jus be say we no get beta result. We go learn sha, try play well."
Na so Liverpool supportas start to cuss Rodgers, wen hin comot Philippe Coutinho for second haf, even tho dem no dey too cuss de bros.
"I bin feel say we no dey see many chance, so I bin dey try change format," na im Rodgers yarn.
"Our supportas na our cement. Dem suppose vex. Dem don see as we chop beating for three strait match dis week.
"I wear undaskirt for de matta. E no worry me. Dem sabi support us well, well. De tin jus pain dem."

Title : Chelsea neva pure - Mourinho
Description : Chelsea coachi, Jose Mourinho no gree hear say hin team fit no chop beating dis season, afta dem waya Liverpool 2-1 on Saturday. Dieg...

0 Response to "Chelsea neva pure - Mourinho"

Post a Comment

Pageviews past week