Chelsea striker Diego Costa no go dey Spain team wey go play Belarus
and Germany dis month afta coachi Vicente del Bosque tok say dem lif am
make hin wound heal small.
"I don relate wit we doctors for Spain hia and for Chelsea sef
and we come decide say make we lif am becos of de injuri wey hin get,"Del Bosque tel repotas dem.
"Hin fit play Chelsea nes game agains Liverpool but dat one no mean say hin no get de same type of wound.
Del Bosque sef don dey shake tins small for de team afta de way wey dem start de kwalifayas and wetin take hapun for World Cup for Brazil.
Hin don call Jose Callejon, Alvaro Morata, Nolito and Ignacio Camacho for de veri fes team do de senior team.
Spain waka for de Euro 2016 kwalifayas no setul at al as dem dey secon for Group C wit jus six points from three matches, and dem dey Slovakia back.
Dem go jam Belarus for dia nes match bifor dem jam Germany for friendly three days afta dat one.
Costa bin kolet lette come for de match agains Slovakia and Luxembourg las mont wey come make Jose Mourinho para come yarn say dem supose allow de guyman de rest.
Callejon be de baba for gols for Italo Serie A now wit eight gols wey hin score for Napoli and Morata sef don dey show enuf form for Juventus.
Nolito form dis seasin solid as hin don helep hin team Celta Vigo dey numba six for La Liga as Camacho sef dey solid for Malaga defence.
"We want playas wey go see road on top field take open door and score gols sef. Na why me invite dem cos dia form dey gud for us,"Del Bosque tok.
"Camacho don prove hinsef for we youth level and hin be champion for Under-17 (2007 European Championship) and Under-21 (2013 Euros). Na 24 years hin be and e dey show as Malaga dey show levels.

Title : No Spain waka for Costa
Description : Chelsea striker Diego Costa no go dey Spain team wey go play Belarus and Germany dis month afta coachi Vicente del Bosque tok say dem li...

0 Response to "No Spain waka for Costa"
Post a Comment