Morocco get from now till weekend for dem to decide weda dem still
wan host ness year's African Nations Cup finals afta de Confederation of
African Football no gree
shift de tournament bicos of de fear for Ebola virus.
Morocco mus tok dia mind for Saturday, naso Caf wey dey control all football matta for Africa tok afta de meeting dem bin get for Rabat for Monday with de prime minister Abdelilah Benkirane and de delegation wey Caf presido, Issa Hayatou be de head yarn.
Morocco wan make Caf shift de date for de tournament to June ness year or January 2016 bicos of de fear dem get for Ebola virus wey don kill almos 5,000 pipu for. West Africa.
But Caf don stamp leg for ground say dem no go shift de date sam sam from January 17 to February 8 no matta say de tournment dey face de risk of getting no other host for de 2015 finals.
But Caf don open dia hand to welcome any country wey fit take over de hosting as emergency hosts, but also yarn say de chance go dey open till Saturday.
But no African country wey get every thing e fit take to host de game don show interest say dem wan host de tournament.
Caf dey vex for Morocco wey kon dey request through de sports ministry lass month say make dem shift de game becos dia health ministry bin advice dem to do so as not to allow de Ebola virus enta for de north African kingdom.
Caf wey no accept Morocco request bin give plenty reasons why de game mus shele for Morocco as dem don consider health matta,wey dem don handle well well, dem also don consider de number of fans wey go enta for de game wey no reach de number wey bin attend de 2014 World Cup, even sef Caf don ban three countries wey get de Ebola virus as dem no go follo for de game,as things bee plenty of de fans wey go enta de stadium be pipu wey live for Morocco wia health condition and matta be ogbonge.
Caf finally tok say dem bin obey all de laws wey World Health Organization bin give about de virus, and also dem kon tok about plenty money wey don enta inside de hosting arrangement, den kon conclude say e go shele for Morocco.
Na for 1988 de tournament bin shele for Morocco lass and dem bin win am for 1976 wen na Ethiopia wey host am.

Title : Ebola no go spoil Afcon
Description : Morocco get from now till weekend for dem to decide weda dem still wan host ness year's African Nations Cup finals afta de Confedera...

0 Response to "Ebola no go spoil Afcon"
Post a Comment