Supa EagusNaija wey na dem be de Baba for Africa go enta de same trouser wit Brazil wey don win de World Cup 5 times for play play match wey go happen by March 29 2015.Na de NFF presido yarn amebo pipu dem for Uyo lass nite say de agent wey dey helep Eagus ontop match matta don confirm say Brazil go jam Supa Eagus.“De plan wey we NFF pipu get na to carry beta match enta dis Uyo international stadium, andI fit yarn unna say Naija and Brazil go kwatta for Uyo ness year March.“We dey even think of anoda padi padi game wit Ukraine or Turkey, but we go do family meeting ontop dat one for us to decide de country wey we go face,” naso Oga Amaju Pinnick yarn.Na de governor for Akwa Ibom, Godswill Akpabio fess tok am say Naija go jam Brazil ness year de time wen de man dey follow Naija pipu tok for de Uyo Stadium.In June 2003 wen Naija and Brazil jam diasef for play play match wey dem take open de Abuja national stadium, de Samba Boys waya Naija 3 kondo for dat match.Sabee strika, Ricardinho waya 2 goals for dat match bifor Ronaldinho kon score de third goal wey Brazil take win de game.
posted from Bloggeroid
Title : Eagus go jam Brazil
Description : Supa EagusNaija wey na dem be de Baba for Africa go enta de same trouser wit Brazil wey don win de World Cup 5 times for play play match wey...
Description : Supa EagusNaija wey na dem be de Baba for Africa go enta de same trouser wit Brazil wey don win de World Cup 5 times for play play match wey...
0 Response to "Eagus go jam Brazil"
Post a Comment