Powered by Blogger.

'City no get mind again'

Manchester City coachi, Manuel Pellegrini, tok say hin playas confido don waka and dem no get mind again, afta CSKA Moscow waya dem 2-1 for house, for Champions League match on Wednesday nite.
City playas tap ball wey worwor, come join yamayama defending inside, plus dem resembu pipu
wey neva see ball bifor, as dem troway match wey dem bin need to win, to try reach las 16.
Afta CSKA strika, Seydou Doumbia score two tines, City vex sotay, dem colet two red card, ad refree purshu Fernandinho and Yaya Toure (na hin bin score City goal) comot.
City neva fit win one match, out of de four wey dem don play for Group E now, and dia road go ruff small, if dem wan enta nes round, sake of say na Bayern and Roma remain to play.
Since 2011, wen dem fes enta Champions League, na so so worwor futbal City dey tap, and as tins don dey ruff for dem for English League sef, sotay West Ham waya dem, den Newcastle come troway dem comot League Cup, Pellegrini tok say gbege full dia side.
"Confido no dey, and mind don go," na im Pellegrini yarn amebo television pipu, Sky Sports. "Since de las two week, we no dey tap de kin ball wey we sabi.
"Na to fin wetin dey hapun, and we go dey follow playas yarn evriday so dat we fit start to win match again. I no sabi why we dey play ball like dis.
"As match start, na so we dey shake, come dey troway pass anyhow. We dash dem de two goal and we no tap shishi. E hard to know why we dey play like dis, wit de kin ogbonge playas wey we get."
Many big club for Europe dey win match, bicos dem dey change de way dem dey tap, wen dem play difrent club.
As dem follow CSKA play so, wit dia helele counter attak, Pellegrini tok say hin playas no gree change dia pattan.
"De way we tap ball so, we no even try change anytin at all," na im Pellegrini tok.
"No be jus Champions League sef. E hard to sabi wetin dey hapun. I neva know how, but we musto fin reason."
City goalie, Joe Hart tok say na onli demsef dem go blame, for dis kin worwor ball for Europe so.
"Na onli wesef, we go look wen we no dey tap beta ball for dis kin ogbonge match. All of us mus yarn de truth, come tink how we go waka from hia," na im Hart tok.
Title : 'City no get mind again'
Description : Manchester City coachi, Manuel Pellegrini, tok say hin playas confido don waka and dem no get mind again, afta CSKA Moscow waya dem 2-1 fo...

0 Response to "'City no get mind again'"

Post a Comment

Pageviews past week