Powered by Blogger.

CSKA do City film trick

Manchester City don dey siddon for botom pot for Group E of de Champions League as CSKA Moscow enta dia side waya dem 2-1 for match wey shele for Etihad.
De two teams bin draw de fes leg 2-2 for Moscow dia
and all men bin dey tink say City go win am easy but CSKA dem get dia own plan as dem chuk hand for City eye.
Ivory Coast strika Seydou Doumbia score de fes gol for dem as hin find space nod beta ball enta Joe Hart net for de second minute of de match.
As City come shock na im Yaya Toure come trow hand hama beta freekik inside CSKA net to make am 1-1 as de team begin dey try luk how dem go take wound de Russia team.
But yawa come hapun for dem as Doumbia come score hin secon gol of de match wit swit shot for de 34 minute. City parade jus pafuka anyhow as both dem Fernandinho and Yaya Toure chop red kad waka as de Russia team wey get we Naija pikin Ahmed Musa carri de three points waka.
For de oda match wey shele for de group, Bayern Munich don do Roma feem trik foe de secon time be dis as dem job dem 2-0 for Allianz Arena.
Na Frank Riberyand Mario Goetze score for fes and secon haf as Bayern don kwalify enta de nes stage for de kompitishun, sometin wey go jolly Pep Guadiola belle well well.
Bayern Munich 2 ( Franck Ribery, Mario Goetze) Roma 0
Manchester City 1 (Yaya Toure) CSKA Moscow 2 (Seydou Doumbia-2)

Title : CSKA do City film trick
Description : Manchester City don dey siddon for botom pot for Group E of de Champions League as CSKA Moscow enta dia side waya dem 2-1 for match wey s...

0 Response to "CSKA do City film trick"

Post a Comment

Pageviews past week