Liverpool coachi, Brendan Rodgers don tok say hin skippo, Steven
Gerrard, no dey shake, as Liverpool dey prepia to face Chelsea for
Premier League on Saturday.
Gerrard own for finish, wen Liverpool bin follow Chelsea play las April, sake of say de guyman fall for
ground, yakata, come let Chelsea strika dat time, Demba Ba, colet ball, go score dem, come pour san-san for Liverpool garri, as dem dey try win Premier League title for de fes time since 1990.
Gerrard don reach 34 years now, and since dat mistake hapun, hin futbal no be as e be bifor, sotay na onli 20 minit hin play on Tuesday, wen Real Madrid kolobi Liverpool 1-kondo for Champions League match.
Liverpool coachi, Rodgers, bin rest oda fes team playas sha, as hin bin yarn say hin wan make dem rest for dia match wit Chelsea, espeshally Gerrard, wey don dey get wound anyhow now.
De gbege be say; Chelsea dey carri 12 point gap Liverpool now, and Gerrard go wan use dis match cancel dat mistake wey hin do las April, and guymen dey feel say de bobo musto tap helele futbal, if Liverpool wan waya Chelsea wey neva troway any match, out of de 16 wey dem don play dis season.
Gerrard don too show hinsef for dis kin ogbonge match, many tines bifor, and Rodgers get confido say hin skippo go sell market.
"Na so Gerrard be. Hin don dey dis kin gbege many tines, but hin dey always show hinsef afta. Nobodi blame am at all. Na mistake wey fit hapun to anybodi," na im Rodgers yarn, wen hin dey tok about de way Gerrard bin fall, even as Chelsea supportas don alredi arrange music for de Liverpool skippo, wey hin go hear many tines on Saturday.
"If no be Gerrard sef, we for no reach wia we reach las season.
"De guyman too much. De way hin don dey play ball since dat mistake, show say hin na baddin guy."
If Gerrard get hin own gbege on Saturday, feem still dey for Rodgers and Mourinho side, sake of say de Liverpool coachi bin yab Mourinho, afta Chelsea waya dem 2-kondo for Anfield (Liverpool stadium) las season.
Chelsea midfilda, Nemanja Matic, pour san-san for de wound again, bicos he tok say na Liverpool monkey, sake of say dem no bin fit opun Chelsea defence.
"Many club don try play onli defence wen dem follow us play dis season, but we still waya dem," na im Matic tok.
"If you wan play defence, you musto sabi defend. We show dem for Liverpool las season, say we sabi.
"Our game don change now sha. Na we dey gap all man ontop table and we dey plan remain dia."
If Liverpool fit waya Chelsea, na Manchester City go jolly pass, sake of say na six point Chelsea dey carri gap dem ontop league table, plus dem fit comot for Champions League sef, afta CSKA Moscow waya dem.
City coachi, Manuel Pellegini go carri hin boys go play QPR (dem tanda for 19 position, second from bottom) on Saturday, and City skippo, Vincent Kompany tok say dem musto wake up sharp, sharp, if dem wan catch Chelsea and do well for Europe.
"All man don see scores. We musto waya team wey fit waya like small pikin," na im Kompany tok.
"All man sabi say we musto wake up."
De tori wey dey sweet evribodi now, na Southampton. As dia forma coachi, Mauricio Pochettino waka comot, wit five of dia ogbonge playas, many guymen bin yarn say dem go suffer for relegate area dis season. Whosai. Na second dem tanda ontop table.
Southampton coachi, Ronald Koeman no dey let dat one deceive am sha, as dem dey prepia to follow Leicester play on Saturday.
"We fit waya dem for one match, but me still believe say na two team; Chelsea and City get power pass. Na so e go be dis season," na im Koeman tok.
"Our main plan na to play for Europe. I get confido say e go hapun."
On Sunday, Arsenal wey tanda for fourth ontop league table, go try forget dia sme-sme match wit Anderlecht on Tuesday, sake of say dem bin dey lead 3-kondo, come allow Anderlecht score three tines, inside 29 minit, to finish match 3-3. Na Swansea dem go wan show pepper now.
"Dat match don show all of us say we musto wake up," na im Arsenal defenda, Per Mertesacker tok.
"Na small tin sha and we go wake up."
Fixture:
Saturday:
Burnley v Hull City Liverpool v Chelsea Manchester United v Crystal Palace QPR v Manchester City Southampton v Leicester City West Ham v Aston Villa
Sunday:
Sunderland v Everton Swansea v Arsenal Tottenham v Stoke West Brom v Newcastle

Title : Eye dey ontop Gerrard
Description : Liverpool coachi, Brendan Rodgers don tok say hin skippo, Steven Gerrard, no dey shake, as Liverpool dey prepia to face Chelsea for Premi...

0 Response to "Eye dey ontop Gerrard "
Post a Comment