Powered by Blogger.

Blues strong pass Reds

Chelsea don pour sand for Liverpool garri for inside dia house afta dem bilala dem 2-1 for de BPL game wey happen on Saturday for Anfield.
Na Liverpool fess score for de match, and naso all Liverpool fans kon dey jolly as dem wan make dia boys spoil de unbeaten run wey Chelsea dey play.

Liverpool take beta nakin start de game, and bifor Chelsea sabee wetin de happen, Emre Can don tear net for de club wey no dey walk alone.
Na wen Liverpool kon score, na hin Chelsea kon open dia eyes kon begin dey tap beta ball wey sweet all man wey watch de match.
Defenda Gary Cahill and Diego Costa be de two playas wey score de two goals wey Chelsea take win dem match for Anfield.
Liverpool fans vex well well wen de match enta mortuary time as dem bin dey shout say de referee suppose give dem penarity afta de wicked shot wey Liverpool skippo, Steven Gerrard play touch de hand of Chelsea defenda, Cahill, but de referee kommot eye.
De koko now be say de kasala wey dey worry Liverpool dis season don dey too much as unna go remember say dem chop 1 kondo lass Saturday for Newcastle United, bifor Real Madrid kon waya dem anoda 1 kondo lass Tuesday for de champions League.
Meanwilly, Chelsea fans juss dey dance kukere afta dem bilala Liverpool for Anfield sake of say dia unbeaten run dis season for de BPL don enta 11 games.
supersport.com
Title : Blues strong pass Reds
Description : Chelsea don pour sand for Liverpool garri for inside dia house afta dem bilala dem 2-1 for de BPL game wey happen on Saturday for Anfield...

0 Response to "Blues strong pass Reds"

Post a Comment

Pageviews past week